1. James Comey: Una remember di tori about how Clinton get private email server when she be Secretary of State for Barack Obama government? Well, she say di way former FBI Director James Comey take dey announce di news up and down anyhow na one of di reasons why she no win. US President, Donald Trump, who win Clinton for di election, come later fire Comey because of wetin?...di way im handle di Clinton email palava.